XMAS CHAT: A LITTLE CHAT DRAMA TO ENJOY YOUR XMAS


As we all know this is the yuletide period and so we decided to get in the celebration mood and catch some fun,here is a drama chat sent by a special friend to be enjoyed by everyone this Xmas and new year.


We are really sorry its coming late,but we want u to have fun this Xmas and catch fun.

The chat is long enough…but also comical for not to bore you…just wanna
wish you happy xmas day…from ibk n tyb…we celebrate our Pastor, Olojede
Johnson and all executives and member of the New Covenant Campus Fellowship…
SEASON’S GREETINGS/

The following dialogue ensued between two friends, Ibk and TyB…ENJOY AS YOU
READ.

TyB: Na next tomao dem go born Jesus ooo
Ibk: O boy...Ehn ehn
TyB: As in...
Ibk: Seriously...I no know o
TyB: E shock me too wen I hear ooo
Ibk: Which hospital for town?
TyB: I hear say na one goat house d woman wan born put sef
Ibk: Haaaaaa
TyB: Na so I hear jare
U know sey d guy still dey para 4 mary
Ibk: Dat one na long thing ooo
TyB: D case strong sotey.... Even God need to dey send angel to bros j ooo
TyB: How she go just carry belle com claim sey na holy spirit giv am.....
Ibk: Ehn but sisi Mary na decent girl ooo…u dey always see am na
Did u hear bout Mummy Eliza's own...dt one better
TyB:yea…her own na miracle something…dey talk say Father Zach no fit talk
sef…
Ibk: but I go like see bros J ooo
TyB: Y u wan c am naaa
Na para mode d guy dey ooo
Him no wan c anybody at all
Ibk: the thing wreck am gan ni yen ooo
TyB: Even God no fit send prophet, na angel God dey send o
Ibk: I hear am…but I no sabi say the thing true
TyB: D Tory na ogbonge one
Ibk: You get Joseph's phone number?
Make hin come our area o…make hin come born hin pikin
TyB: O boy...na true talk u yan for there…Waoh
But me don loss hin contact o
TyB: U get hin BB pin?
IBK: No na...shey hin dey bb ni…but sisi Mary sef get phone
IBK: I mean bros j no dey ping
TyB: Ehn ehn… Imagine! Hin still dey reply people for last week…U know sey
him guys just dey use am do yeye since dat kasala burst
TyB: Him intentionally off im data
Ibk: Waohhhh… Lobatan
IBK: How we go locate den now
TyB: Dem say im babe dey 4m virgin…Na so bros j para jare…The tweet they
trend gan for the past two weeks
Ibk: Ehnnn…sisi Mary nko
TyB: U 4get?
Ibk: abi…oooo…I remember… Dem talk say Mary no get phone
TyB: She get bt bros j seize am… No network 4 dat side sef..
Ibk: Network go dey...abeg gimme
TyB: I go check am…but I no think say I get am…na my papa dey roll with am
wella…two of us no too dey yan
IBK: Well...you know say we be wise men...I kon deem am fit say make we
give them gift...
Abi wetin u think...?
TyB: Omo! Na good one be that…but How we wan even take knw d place?
IBK: Na d tin be that...
Make we use Google earth...
TyB: Ehnehn???
TyB: But e b like sey God promise us one star naa
IBK: Ehn ehn...shey hin promise us?
IBK: I never see anything...infact I use my glasses look I no see anything o
TyB: Na to chill first o
TyB: Bt mk we first tell bros j sey we dey come ooo
TyB: M8A548RY
IBK: Ohhhh
IBK: You don get sisi Mary pin...correct
TyB: Na her bb pin be that…na my sister cord kon send am for me
IBK:you too sure…where you get am sef… I go ping her now…bros j for don
return the phone to hin girlie
TyB: Good
TyB: Tell me wetin she talk so we go start to dey plan
IBK: Aite…I go copy una
IBK: Last seen was this afternoon...
TyB: E mean say she go soon come online b dat
IBK:her Status funny… "with God nothing shall be impossible*"
IBK: yea… I go dey check her...
TyB: No p… Just holler if she dey online
/30 minutes later/
IBK: Haaaa… She dey online o
IBK: I'm chatting with her aiidy
TyB: Wow
IBK: [7:43PM, 12/24/2015] Pristine: hello sister mary...*
[7:58PM, 12/24/2015] Mary(saint): hi...good evening! pls who's
this?
[7:59PM, 12/24/2015] Pristine: I'm ibk...I was the one whom your
husband constructed a cupboard for...the one he painted green
IBK: She don comot again…
TyB: Just dey follow her…beep me as soon as she don return
IBK: She’s back…but she no wan chat…see wetin se write
[8:30PM, 12/24/2015] Mary(saint): OK...good evening...pls can I
chat up with you later...
[8:58PM, 12/24/2015]Pristine: hmmm...no problem. I'm a
friend...to bros Joseph. I tried calling...he wasn't picking the call... I
heard about your wonderful story of birthing the new King...
TyB: Wow
TyB: We're making progress anyway
Ibk: I don see dem star oooo…
TyB: Omo na to set off b dat oooop.....no time!
IBK: I don see star o… For bodija side...
TyB: I believe una…na tush place the star go show…but na wowo place hin go
lead us to…lol
TyB: But Which gift we go com buy now???
IBK: Ehn ehn…na so bible talk am…dt gift???Na d thing be that...
IBK: I get one gold feeding bottle...
IBK: How about dt?
TyB: Abi mk we buy pampers?
IBK: Hmmmm
IBK: Myrhh pampers go make sense...I swear…myrrh dey ever scent wella
TyB: Golden pampers
IBK: Haaaa...u wan make Mary no dey throway am after usage? Na gold we dey
talk o....infact Joseph go hoard am!!!
TyB: Omo na true b dat… So wetin mk we do nw?
/2nd day…Dec 25/
TYB: Mary don born oooooooooo0
IBK: how u sabi?
TYB:Tweeter…den talk say “a king is born”…na to rejoice ooooo
I don dey celebrate…
IBK: I go come your side now now now…oyaaaaaaaaaaaaaaaaaaaaaaaaaa…
A KING IS BORN…
TyB: I don get frank-handkerchief and some myrhh pampers…carry your gold
feeding bottle and lets go worship the new born king
IBK&TYB: Come and behold him…come let’s worship him…
gloryyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyyy

SING WITH ME:
Thank You the Saviour of my soul,
You are saving me to the uttermost,
You are making me whole,
Thank you the Saviour of my soul.

JESUS WAS BORN (MADE FLESH), Jn 1:14…THAT HE MAY DELIVER US FROM OUR
SINS,Mt.1:21, AND NOT OURS ALONE, BUT THE SINS OF THE WHOLE WORLD,1
Jn.2:1-2.
AND TODAY, WE REMEMBER(NOT THAT WE FORGOT,BUT WE CHOOSE TO ACKNOWLEDGE AND
ASCRIBE THIS DAY) TO COMMEMORATE AND CELEBRATE A DAY THAT DIVINITY
DESCENDED INTO HUMANITY FOR TO MAKE HUMANITY ASCEND INTO DIVINITY.
THIS GIFT OF GOD THAT BRINGS SALVATION HAS APPEARED UNTO ALL MEN,Tit.2:11…YOU
CAN RECEIVE THIS GIFT, JUST BY BELIEVING,Rm.10:17, THAT HE BORE YOUR SINS,
DIED, AND WAS RESURRECTED, ALL FOR YOU,Jn.3:16.
FOR AS MANY THAT BELIEVE, HE GAVE THEM THE POWER TO BECOME SONS OF
GOD,Jn.1:12, AND IF SONS, THEN HEIRS WITH CHRIST Rom 8:17

HALLELUYAH.


Composed by:
Tayo Bello and
Akinlade Ibukunoluwa

0 comments:

Post a Comment

 
Top